Monday, April 29, 2024

Rabiu Musa Kwankwaso: ‘I beta pass Peter Obi na why I no step down for am’

- Advertisement -spot_imgspot_img
- Advertisement -spot_imgspot_img

Wetin we call dis foto,

Rabiu Musa Kwankwaso

New Nigeria People’s Party presidential candidate Rabiu Musa Kwankwaso for exclusive interview with BBC Hausa tok say di reason why e no step down for Labour party presidential hopeful na because records show say e dey beta.

For June 2022 discussions bin happun after Nigerians ask for di two candidates to come together to create third force wey go battle APC and PDP wey be di two leading parties for next month’s election.

According to Kwankwaso apart from govnor of Anambra and trading wey Peter Obi do, e no get any oda major work experience unlike am wey don serve in various capacities.

“Peter Obi apart from Anambra govnor na only trading e do, you no fit compare am to me wey work with goment for 17 years wey im (Peter Obi) no do, I serve as deputy speaker for Assembly wey im no do and I govern Kano state.”

“I play part for constitutional conference wey im no do, I serve as senator wey im no do, di only thing to compare na say e serve as govnor just like me but my own govnorship na for Kano while im own na for Anambra.”

“I also work with NNDC wey im no do infact even if you check our educational qualifications no be di same.” Dat na wetin Kwankwaso yarn.

Di former Kano govnor also speak about di campaign rallies so far and im party chances for di upcoming election saying dia chances dey bright and e get feeling say na im go win.

Kwankwaso like Peter Obi defect from Peoples Democratic Party not too long ago afta e form im own party di NNPP.

Both candidates in dia 60s serve as govnors of dia various states for eight years, although Kwankwaso first emerge as govnor for 1999 wen Peter Obi neva even contest any election for im political career.

Di two politicians dey among di 18 candidates wey dey eye di highest political seat for Nigeria.

Di presidential election go happun for 28 Feberuray, 2023.

Rabiu Musa Kwankwaso profile

Rabiu Musa Kwankwaso na former govnor of Kano State wey lead di state from 1999 to 2003 and 2011 to 2015.

Di politician na native a of Kwankwaso town of Madobi Local Goment Area of Kano State.

Oda positions wey im don hold before na Deputy Speaker of House of Representatives, Minister of Defence, Board Member of NDDC and former Senator of the Federal Republic of Nigeria. 

For 2015, Kwankwaso contest di presidential primaries under di All Progressives Congress but im lose to Muhammadu Buhari.

For 2018, Kwankwaso return to People’s Democratic Party and im contest di presidential primaries but im lose to Atiku Abubakar.

And for 2022, e komot from PDP to join di NNPP where e dey represent di party as dia presidential candidate for di 2023 general elections.

Peter Obi profile

Peter Obi na politician and businessman.

Im na former govnor of Anambra state for southeast Nigeria. 

E serve two term between 2008 to 2016.Oga Obi bin dey All Progressive Grand Alliance (Apga) before e join PDP for 2017.

Im also be sabi pesin for wetin concern economy matter.For 2019, e come out as vice presidential candidate of Atiku Abubakar. But dis year 2022 e don decide to go for di president position.

Peter Obi say im administration as president go create jobs, boost Nigeria economy, and improve education.

- Advertisement -spot_imgspot_img
Latest news
- Advertisement -spot_img
Related news
- Advertisement -spot_img

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

%d bloggers like this: