Thursday, March 28, 2024

Indonesia: Death toll for Java earthquake kontinu to rise

- Advertisement -spot_imgspot_img
- Advertisement -spot_imgspot_img

  • By Tessa Wong & Simon Fraser & Alys Davies
  • BBC News

Wetin we call dis Video,

People were rushed to hospital in Cianjur in the aftermath of the earthquake

One earthquake don strike di main Indonesian island of Java and kill at least 56 pipo and injure hundreds of pipo, local officials tok.

Di 5.6 magnitude quake strike Cianjur town for West Java, at shallow depth of 10km (six miles), according to US Geological Survey data.

Dem rush many pipo to hospital and treat a lot of dem outside.

Rescuers bin work into di night to try rescue odas wey pipo believe say dem still dey trapped under collapsed buildings.

Di areas wia di quake strike dey densely populate and prone to landslides, and poorly built houses for many areas destroy.

Di exact number of pipo wey die for di earthquake neva clear.

Indonesia National Disaster Mitigation Agency (BNPB) bin say di death toll na 62 – dem also say di regional govnor Ridwan Kamil put di figure at 162 – BBC neva verify am.

Oga Kamil during interview wit local tori pipo say 326 pipo wunjure for di quake, “most of dem sustain broken bones as dem dey avoid make di ruins no crush dem.”

But e tok say some residents still dey “trapped for isolated places” and say officials believe “under di assumption say di number of injured and deaths go rise wit time”.

Di West Java govnor add say more dan 13,000 pipo dey displaced by di disaster, and di BNPB say di quake damage more dan 2,200 homes.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto,

One collapsed school building for Cianjur

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto,

One damaged classroom for Cianjur

Earlier, Herman Suherman, di head of administration for Cianjur town, say most injuries na bone fractures wey pipo wey dey trapped under di remains for buildings sustain.

“Di ambulance dem keep on to dey come from di villages to di hospital,” na so AFP quote Suherman. “Many families dey for villages wey neva dey evacuated.”

Dem treat many injured pipo outside di hospital sake of di hospital no get light for several hours afta di quake, West Java govnor tok.

Dozens of buildings dey damaged for Cianjur region, di National Disaster Mitigation Agency tok for inside one statement. E include one hospital and one Islamic boarding school.

Di capital Jakarta wey dey 100km away also feel di shake, and dem evacuate pipo wey dey for high-rise buildings.

Office workers rush out of buildings for di civic and business district during di tremor, wey start at 13:21 Western Indonesian time (WIT) on Monday, di agency tok.

“I bin dey work wen di floor under me dey shake. I feel di tremor well-well. I no do anytin sake of say I wan process wetin e be, but e become even stronger and last for some time,” lawyer Mayadita Waluyo tell AFP.

One office worker Ahmad Ridwan tell news agency Reuters say: “We don dey used to dis [earthquakes] for Jakarta, but pipo bin dey nervous just now, so we sef panic.”

Earthquakes dey common for Indonesia, wey sit ontop di “ring of fire” area of tectonic activity for di Pacific. Di kontri get history of devastating earthquakes and tsunamis, and more dan 2,000 pipo die for one 2018 Sulawesi quake.

- Advertisement -spot_imgspot_img
Latest news
- Advertisement -spot_img
Related news
- Advertisement -spot_img

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

%d bloggers like this: